Hajj 2024: Wetin dey happun to pesin wey die for pilgrimage for Mecca? - BBC News Pidgin (2024)

Hajj 2024: Wetin dey happun to pesin wey die for pilgrimage for Mecca? - BBC News Pidgin (1)

Wia dis foto come from, Getty Images

Hajj na one of di most important tins for Islam. E follow for di five pillars of di religion and e dey obligatory say anybodi wey get di means must to perform at least one Hajj pilgrimage for im lifetime.

Evri year around dis period, millions of Muslims from all ova di world dey gada for Mecca, Saudi Arabia, wey bi di holiest site for Islam, to perform dis holy ceremony.

Most times, pipo wey embark on dis travel no dey come back alive, some of dem dey kpai dia sake of one tin or anoda, like stampede, accident, or illness.

For di ongoing 2024 Hajj pilgrimage, two Nigerian pilgrims - Tawalkatu Busare Alako and Muhammad Suleman, both from Kebbi State - don die for Mecca, according to di National Hajj Commission of Nigeria (NAHCON)

Di chairman of NAHCON, Jalal Ahmad Arabi, bin release one statement on Sunday wia e condole wit di families of di deceased and also pray for di repose of di souls of di dead.

Skip Recommended articles and continue reading

Recommended articles

  • ‘If I die today dem go put me inside’ - Man wey dey build ‘Makara’

  • Israeli strike hit Rafah area hours afta Hamas bin fire eight rockets towards Tel Aviv

  • Eid al-Fitr for Jerusalem - ‘Joy no dey’

  • Wen be Eid al-Fitr and how dem dey decide di date?

End of Recommended articles

So wetin dey happun when pesin from Nigeria, for instance, die during Hajj pilgrimage for Mecca? To die during Hajj pilgrimage get any religious significance?

Na privilege to die for Hajj - Cleric

Normally, especially for Africans, pipo dey prefer to bury dia deceased relative for dia ancestral homes make dem rest wit dia ancestors. Many times pipo dey go extra level, do plenty expenses just to bring di deadi bodi of dia loved one back home for burial.

"I neva see anybodi wey die for Hajj wey dem bring im deadi bodi back," Umar Haruna, wey be Islamic expert tok.

  • 'Na three years I don dey save for Hajj, where I wan see almost N2 million?'
  • Arafat day: Why e dey important for Muslims
  • Hajj 2021: Why Hajj dey important for Muslims as Saudi Arabia ban foreigners

"In fact na somtin of privilege to die for di holy land. Even di relatives of di deceased, although dem go dey feel pain ova di death of dia loved one, but dat pain dey reduce well well sake of di belief say na blessing from Allah."

Also, Islam prescribe say e good to bury pesin as soon as possible afta dem don die, and dis na normally within 24 hours afta death.

"E no possible to follow di process of bringing back pesin deadi bodi within 24 hours, so dem just dey bury dem for Saudi dia," Haruna tok.

Wia dem dey bury dem

Anoda cleric Imam Nurudeen, wey don go Hajj pilgrimage multiple times, tell BBC News Pidgin say e get a number of cemeteries wia dem fit bury pesin wey die during Hajj.

Some of di well known cemeteries na Jannat Al-Mala for Makkah, Jannat Al-Baqi for Madinah, Al-Adl cemetery, Al-Haram Martyr’s cemetery, Al-Rabway Cemetery, and Arafat Cemetery.

For 2015, wen ova 2,000 pilgrims die for stampede for Mina, di Saudi Arabia authorities tok say dem prepare enough graves across di six cemeteries to bury di victims.

Some Nigerians follow die for dat incident, including: Adeola Maurufudeen Adefolabi, a former Lagos State Assembly member; Tijani El-Miskin, a professor of Islamic Studies for University of Maiduguri; and Hajiya Bilkisu Yusuf, a popular journalist.

How di burial process be?

Sulaiman Aliyu, wey be Pharmacist for Ahmadu Bello Teaching Hospital, Zaria, Kaduna State, explain to BBC Pidgin di processes dem dey follow bifor dem go bury pesin wey die during Hajj.

Aliyu don be part of di Hajj medical team on a number of occasions.

E tok say: "First of all e dey depend on wia di pesin die. A pilgrim fit die for hospital, or for inside di Nigerian clinic, bicos NAHCON get dia own clinic for di holy land, or di pesin fit die for inside im hotel room.

"If di pesin die for hospital, di hospital authorities go write a report and forward to Nigeria Hajj Commission, den NAHCON go call di attention of di state wia di pilgrim come from to inform dem on wetin don happen, den dem go forward di report to di Saudi security and also di Saudi ministry of health and di Saudi goment.

"Dis na to make sure say all procedures dey followed and all parties dey carried along bifor dem go proceed for di burial.

Additionally, Imam Tajudeen explain say di burial process no dey different from how dem dey bury a Muslim for any part of di world.

"Dem go first wash di bodi, den wrap am wit di Kafan, wey bi simple white cloth, den at di cemetery, one Imam go lead di pipo to recite di funeral prayers or Salat al-Janaza, afta dat, dem go bury di pesin," e explain.

Hajj 2024: Wetin dey happun to pesin wey die for pilgrimage for Mecca? - BBC News Pidgin (2)

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin Hajj mean to muslims?

Hajj dey compulsory for all Muslims wey dey physically and financially able to make di pilgrimage.

But dat one na on di condition say dia absence no go place hardships on dia family.

Pesin fit perform Hajj by proxy, meaning say e fit appoint im relative or friend wey dey go for di pilgrimage to "stand in" for im or her.

Na Prophet Muhammad establish Hajj, but variations don arise afta den, and di itinerary no dey strict like bifor as pipo no dey follow all di instructions wella.

About two million pipo dey perform Hajj for Saudi Arabia evri year.

Hajj 2024: Wetin dey happun to pesin wey die for pilgrimage for Mecca?  - BBC News Pidgin (2024)
Top Articles
Latest Posts
Article information

Author: Carmelo Roob

Last Updated:

Views: 6323

Rating: 4.4 / 5 (45 voted)

Reviews: 84% of readers found this page helpful

Author information

Name: Carmelo Roob

Birthday: 1995-01-09

Address: Apt. 915 481 Sipes Cliff, New Gonzalobury, CO 80176

Phone: +6773780339780

Job: Sales Executive

Hobby: Gaming, Jogging, Rugby, Video gaming, Handball, Ice skating, Web surfing

Introduction: My name is Carmelo Roob, I am a modern, handsome, delightful, comfortable, attractive, vast, good person who loves writing and wants to share my knowledge and understanding with you.